Wednesday, 3 June 2026
Kasala Inside NDC As Some Groups Tok Sey Make Dem Confirm Ogadinma As Consensus Candidate
Kasala don dey start for Abia State inside the Nigeria Democratic Congress (NDC) as two pro-democracy groups don dey press the party leadership make dem accept Hon. Hapuruchi Ogadinma as consensus candidate for Obingwa/Osisioma/Ugwunagbo Federal Constituency House of Reps seat ahead of 2027 election.
Di groups, wey be Nigeria League for Good Governance (NLG) and Forum of Abia Democrats (FABD), talk sey di party suppose respect “people mandate” and zoning arrangement when dem go settle di matta of the inconclusive primary wey NDC do recently.
For joint statement wey dem release after meeting wey hold for Abuja on Sunday, di groups, through NLG President and FABD Convener, Surveyor Samuel Aguiyi, warn say if di party no handle the matta well, e fit cause division inside Abia chapter of di party.
Dem still talk say di leadership of the Nigeria Democratic Congress suppose act fast to avoid internal fight wey fit spoil their chance for 2027 election.
According to dem, Hon. Hapuruchi Ogadinma get better grassroots support for Obingwa, Osisioma Ngwa and Ugwunagbo, and naim make am the best person wey fit carry di party flag.
Dem still tok say Ogadinma get strong acceptance from party members and ordinary people for di constituency, and say that one alone fit help NDC win election.
Di groups explain say Ogadinma get experience, correct education background and leadership skills wey make am capable to represent di people well for National Assembly.
Dem still add say zoning arrangement for di area dey favour Agalaba axis for Obingwa area, and say political fairness and balance na wetin dey guide the system for di constituency.
At the same time, dem call on party leadership make dem no take any decision wey go increase tension wey already dey ground after the inconclusive primary wey happen last Friday.
Dem warn say if party no manage the matter well, e fit affect their chances for all di three local government areas wey dey inside di federal constituency.
Di groups conclude say Ogadinma candidacy fit bring new level of development and better representation for di area if NDC give am ticket.
As matta dey unfold, party stakeholders still dey discuss how dem go settle di disagreement and bring one united candidate before 2027 election.
For now, political tension still dey rise as different interests dey position themselves for di battle wey dey come ahead of 2027.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Calabar Fire: “E no easy to loss business wey don stand”, NGO console victims
The Ben Akak Foundation don express sympathy to business owners, traders, workers and oda people wey dem affect by di fire wey happen for ...

No comments:
Post a Comment