![]() |
ABUJA – Cross River youths don salute Governor Bassey Otu and im deputy, Peter Odey, as dem mark three years for office, say the governor don try well-well for youth matter, empowerment and development of the state.
The Chairman of Youth Council of Nigeria (YCN), Cross River Chapter, Emmanuel Olayi, tok dis one during di Town hall meeting wey do state hold for Abuja to celebration Otu three years anniversary for office.
According to am, the youths for Cross River dey happy with wetin di governor don achieve so far, especially di way e don carry young people join bodi for government and leadership matta.
Olayi say as representative of Cross River youths, e come thank Governor Otu for di opportunities wey e don create for young people to grow, learn skills and contribute to di development of di state.
"His Excellency don show over and over say e get love for young people. Na why we come dey appreciate am for di deliberate effort wey e dey make to carry youths along for governance and leadership," Olayi tok.
Di youth leader also use di chance hand over di report from di state-wide Future First Unity and Assessment Tour wey dem carry go all di local government areas for di state.
According to am, di tour give dem chance to hear directly from young people about their challenges, expectations and suggestions on how government fit do better.
E say di report contain important findings and recommendations wey go help government understand wetin dey for di minds of youths across di state.
As part of the event, Olayi also present wetin di Youths call "Seal of Appreciation and Endorsement" to Governor Otu on behalf of Cross River youths.
E explain say di recognition come out from the grand finale of di state-wide youth unity and assessment tour, and na way of appreciating di governor for im commitment to youth development and empowerment.
Di NYCN chairman also remember di "Not Too Young To Lead" campaign wey di council launch before party primaries. According to am, shortly after di campaign, many young people get opportunity to contest and secure party tickets.
E come call on other political parties and leaders to dey intentional about youth inclusion, saying young people suppose no just dey follow politics from back, but make dem dey involved for decision-making too.
Olayi still advise youths for di state make dem take responsibility and use every opportunity wey dem get to contribute positively to society.
"As youths, we no go just dey ask for opportunities. We must show say we fit handle responsibility when opportunity come. Na our turn to help build the Cross River wey we want see," he tok.
Di youth leader come assure Governor Otu say Cross River youths go continue to partner with im administration to ensure peace, unity and development for di state.
"From the youth community, we wan make His Excellency know say we stand gidigba with am. We go continue to support every genuine effort wey go move Cross River forward," Olayi talk


.jpg)

